Wednesday, July 9, 2008

UNA NO VOTE ABI????????????

Hi people............

una no vote for me abi?
for www.blogvilleidol08.blogspot.com

i dey go VILLAGE for ALL of una
as una know say una no go vote
when i talk say i wan sing
una for tell me say
no sing o..........
we no go vote o.......

i come go finish
una do me
ma lo....awa le hin e
na so i look back.........i no see person

i dey vex gannnnnnnnnn........

i no go blog again sef...........

cos na so i go say i wan turn
chief or mistress of this our obodo
una go do me wayo again
mschewwwwwwww...........


but sha
as una no vote for me
continue..........
cos no matter wetin happen
one person must carry bucket sorry cup
at the end of the whole thing

so.......go dia.....go vote

but no forgeti dey go villa this sat
FOR ALL OF UNA!!!!!!!!!!!!!!!

18 comments:

Aphrodite said...

lmao...
abeg no vex for us. Maybe ur singing pass our level,lol...

But come o, u no get even half vote?? Maybe u need to go village go find out wetin happen

lol...

love ur blog, so real.

LG said...

@one person must carry bucket sorry cup,
hehehehehehe ib, so na bucket dem wan give d winner, naim b say u lucky o, lollllllll
but swerry, how u take kno say i no vote for u, HOW??????

BTW i forbid u to travel o, no mind aphrodite jare

Flourishing Florida said...

hahahahahahaha

am laughing @ ibiluv & @ aphrodite 4 saying her singing pass our level. i can just remember how i burst n2 laughter wen i heard ibi my luv sing. i wan die

ibi, i no tell? ah. check am well o. lmao. but no mind us, d thing b say plenty pple sabi too much, so dem com comot una wey sabi only small. lol

abeg, no go village 4 us o. pls, forgive n forget

Nine said...

Dem comot you eh?Kpele.No waste ur money begin go villa oh;fuel dey cost.Lol.

Dami said...

me i vote for you o..
just saw you didn't make it to the second round..pele
next time day :)

ablackjamesbond said...

Pele...try dancing...lol

Enigma said...

Life goes on my dear... no mind dem... just keep singing... your own music..the one that comes from both ends *wink*

Chari said...

buahahahahahahaha!

No mind them jare my dear!

we are forgeda!

Caelestis Angelus! said...

lol

princesa said...

LOL!
Better luck next time dear.

In the meantime, you fit drink plenty egg and honey ready for next year version,lol!

archiwiz said...

LOL....No go village abeg ohh... Me too I don commot, but I get wonderful present to take replace am... So e go berra.

Tairebabs said...

lol!!! abeg no vex. me I no know when voting end for that round self. no go village abeg e go just catch me straight!

LG said...

IBI i nor undastand u o, werrin dey happen, abeg come n show som luv jare

Jinta said...

i think you've put the fear of God in everyone

BlogVille Idol said...

Hello ,its me once again remindng you that the blogville idol contestants 08 have sung their OLDIES jams!!!this session in on FIRE!!..Pls go over to the page listen to the contestants and then VOTE!!!dont forget to drop us a kind comment!tanx

Nigerican said...

U no say i no dey blogville for a while. if to say i dey, i for vote since since.

Anyway welcome to my club... last year , upon all my begging na me them vote off first.

If u decide to go village, abeg, help me join those people way no vote for me inside u're own. Much appreciated

LMAO... luv u girl :)

Chari said...

come dis babe update na abi wetin?

ibiluv said...

@aphrodite......yea u know girl....i am too hot for blogsville idols....i do the singing from both ends kind........just got back from the villa.....i plan to visit them all,1 by 1-dem whey no vote me dey tell me say them b my people.....u love me blog????...*blush*...i aim to please....

@LG.....i no talk say u no vote...but u for carry supporters join......ur name dey list say na ONLY once you vote.....*if i catch you*......

@freeflowingflorida.....yea babes...u think say na laff i wan elicit for idols abi votes????.....i dey come....ur own punishment dey cooler.....

@nine...i be biggie....i fly go villa ni..fuel no be my problem....God save you them say na 50times you vote....who u bribe for villa????cos my vote no reach 50*&^%$£%^....

@iyalode....my july salary na you get am cos na u vote pass.....but na cedis i go take give you.....i go mail you the rendevous for collection.....*wink*...

@ablackjamesbond.......no try me...all the laurels in my room na for dance...abi..no be that thing whey we dey do under/on top of man be dancing....*scratching head*.....

@enigma...u know how i do....*wink*....i have 2rooms full of grammys from *that* kinda singing......

@charizard......u dey laff with me or at me????.....

@twix....hi....

@princesa.....are u suggesting my voice no good.....*carrying mortar*.....

@archiwiz......dem don comot you tooo???where dem dey???....

@tairebabs....God save you say you confess.....*dissipating anger*.....

@lg......hi darling.....u sef lucky dem say u vote 90times...you sure you no go villa before me.....

@jinta.....i did-didnt i....they know not to try me next tyme.....*wink*......

@blogvilleidol...be dia in a hot minute.....

@nigerican.....no mind dem.....na the berra people dem dey comot first....*grin*....

@chari....no mind me....na rain beat my system....*wink*.....